APGA, LP, FIFA, CAF,EFCC, NFA,NPF, PDP all na the same!!

Na Igbo man de talk say you no fit beat pikin come talk say make e no cry. But for Nigeria matter, if dem beat pikin, dem go say e must not cry. Yesterday, i de look for TV where Nigeria police de shoot people (especially women) teargas. Wetin dem do? Dem de protest against impunity for Nigeria. dem come jam impunity hehehehehe. i de laugh? How I for no laugh. Na OBJ teach me. Man wey koro-koro eye de campaign to change constitution so dat e go be president for twelve years. With im brother Fani-Kayode. When we de ask am say, does the president want a third term, e de answer say, the president will do nothing unconstitutional. When the thing no work, Baba turn around say no time wey im pursue dat kind agenda. I de laugh. But dis laugh no be sweet laugh. Why I de laugh? Make i ask the question on one different line so dat you go see am wella.

If those protesters de support oga pata-pata, dem for shoot dem tear gas?

see another question.

That one wey oga madam carry women do take support her husby, police no see tear gas dat day abi electoral act go leave?

One kind spirit na im de run for some people vein, na the spirit of Robert Mugabe. When I learn Social Studies first-first, na Mugabe be president. I wan retire for work, Mugabe be president. Victor Uwaifo take am sing dat time. We don forget the song, Mugabe na still president. That spirit wey de show am way, na im enter all this people with short-short name wey make dem de do things like say na dem papa plant this world.

i no like long talk. Make I cut am short. Na LP de make me laugh pass. Dem de romance devil and dem think say dem get sense. Make dem go read wetin David do. Prophet tell am say you get many sheep but when you get visitor, na the only one wey your neighbour get you kill for your visitor. I know say una no go understand sef.

APGA don try PDP magic but even with PDP support dem fail am. Oya na. Election don hold. Make una give us report card na.

FIFA and CAF de change position of goal post any time dem like. Now dem say many people never vote for world player, so dem go delay small make other people vote and so that the ones wey don vote go fit change dem mind… mad men. CAF na year by year. Issa Haiyatou go be president from the grave sef. And as long as vote na one per country, Francophone don finish matter. And na GLO money dem de chop.Glo go de do advert. To do network make e fine no let dem.

EFCC na Roger. That oyinbo dog wey de hear English. If the master say, ‘Roger bark,’ e go bark. ‘Roger Bite…na the same with dem sister ICPC. Na Mugabe spiritt dem get.

NPF no be Nigeria Police o…na National Providence Fund i de talk o. Small time now, dem go say I de abuse police. I no call una name o. Make I just jump dat side. Make me sef jump NCAA, NNPC.

who come remain….haaa na dem father be dat….if i start…if i start…..

Na the same wicked spirit wey de spoil premiership match, wey dem de give somebody fake penalty for extra t8ime and allow 9 minutes time added on….God punish dat spirit.

 

 

dem say oga sick, who send?

E get some time wey person go talk and all man go de think say person wicked. i dey for traffic wey be say person wey take leg de waka de overtake me. Everywhere na smoke and dust. i manage reach where i de go after two hours late. i enter house, light no dey, dem no pump water, the queue for street borehole na craze. i just manage get small network take check internet and wetin i de see so?

Dem say oga de sick for yonder and dem tell am say make e go rest small. dem come de tell us say make we no worry, say e no serious. Naija official dem can de form!!

OGA SICK, WHO SEND AM?

Ok sha. We de try form for oyinbo dem say oga popular and all man don carry fasting and prayer and binding and loosing because oga sick. i hear una o. Who de carry fasting for us? We wey don de sick since oga be oga?

But some kind talk dey sha o. Wetin the docki dem for Aso Rocky de do wey e be say na oyinbo  docki dem go look microscope take tell oga say make e go rest? Wetin be dat? Somebody gat to tell those people say dem no do well o. All the money dem de collect, dem wan make oga go faint for front of foreign camera. Laast time, some say e enter toilet, e sleep go come forget say e get speech. Chai!! Some people get bad mouth. I no follow dem talk blasphemy o. Na only hear i hear and as i no dey der, I just comot ear.

But again, Broda Rubby go de arrange imself well, abeg. See the way e de tell us say make we no worry. Wetin we for like ask Broda Rubby be say, wetin oga de do wey e come tire reach make oyinbo give am warning? If we turn am to WAEC question, how e go be?

Question 1. Wetin make oga tire reach oyinbo advice?

a. Na the work wey dey the job wey e take

b. Na the wahala wey im party de give am day and night esp Oyinlola/Lamido

c. Na Akande, Amaechi, Baraje and Lai Muhammed de take winch fire oga

d. Na sapele water don too much (no choose this one o)

e. Na Anambra election give oga wahala

Anyway, any one you choose, na you by yourself go explain am. I no dey o.

All i know be say make Rubby no just de form for dat side. Oga no well. Na people wey de see de chop there, na dem go de worry. But I gat to play my part as a responsible patriotic citizen now. I de find Sina Peters number. Make Sina Peters come compose song for oga. WE ALL WISH OGA SOONEST RECOVER!!!!

Oga sick…na who send?

Na play i de play o….I SEND O!!!!!!!

…na so e go de be…..

people wey know book pass us de talk say pidgin na for people wey no de hear grammar. Na dem own be dat. But when e reach time for election, na so all of dem go de try speak pidgin and na wonder dem de take dem mouth commit. Na dem know. For this zone, we go de do we thing. We go de talk our tori, we go de discuss and we go de translate the beta beta news make we for de know wetin de happen. People, una welcome o. Na we own homezone be dis.

i de come, make i find kolanut go first. abi you no go chop?